141 Even doh I nor mean anytin at-all to pipol, I nor go fit forget yor kommand.
But naw, I don turn worm instead of man. Evribody hate and dey laf mi!
Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.
My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?
Jesus kon tell am, “Rabbits get whole, birds get nest, but Man Pikin nor get anywhere to put en head!”
Den Jesus look en disciples, tell dem, “Make una happy, una wey dey poor, bikos na una get God Kingdom.
E betta to dey honest even doh yu nor get plenty money, dan to use wayo get plenty propaty.
E betta to get small propaty and still dey fear God, dan to get evritin with many-many wahala.
My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.
Even doh my life nor balance at-all, I nor go stop to obey yor kommandment.
I dey poor and I nor get anytin, so make God keep mi for en mind. My God, make Yu kwik kom, bikos na Yu bi my help and di Pesin wey go save mi.
Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.
E betta make pesin dey poor and get good karata, dan make e bi fool wey nor get trut for mout.
I dey waka go like sheep wey waka lost for bush, so make Yu kom find mi, bikos I neva forget yor laws.
I go obey yor laws and I nor go forget yor word.