Anybody wey dey porshu and won kill yu, di Oga yor God wey dey heaven go protet yor life and nor-tin go happen to yu. But e go skata and kill yor enemies, wons and for all.
But David sey, “Yor papa know how yu like mi well-well and e don gri for en mind sey, ‘Make I nor let Jonatan know about dis matter, bikos if e know, e nor go dey happy!’ But as long as God dey alive, na small tin make mi neva die!”