Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 116:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 God dey protet pipol wey dia faith neva too strong and even wen I dey face deat, E kom save mi!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 116:6
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make Yu hear my prayers, bikos I don taya. Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi, bikos dem too strong for mi.


God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.


Make Yu nor kount awa grand-grand papa dem sin against us and bikos Yu dey sorry for pipol, make Yu kwik-kwik kom ansa us, bikos e remain small make wi die finish.


As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.


One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.


Una wey bi savants, make una obey una mastas (dey do wetin dem tok) for evritin and nor bi only wen dem dey look una. Make una nor dey do like pipol wey wont make dem praiz dem, but make una dey obey with betta mind, bikos una dey fear God.


But I dey fear sey, just as di snake deceive Eve with en wayo, una mind fit spoil komot for di true and di way wey una dey follow Christ.


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


I dey happy, bikos evribody don know how una dey obey God. But I wont make una dey wise wen e rish matter wey koncern wetin dey good or bad. Make una nor do any bad tin.


Even doh God save dem many-many times, dem still choose to sin against am and dia sin kon finally distroy dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka