Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 115:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Awa God dey for heaven and E dey do wetin E like.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 115:3
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E dey do anytin wey E like for heaven and eart, both for under di sea and ocean too.


Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


God don make heaven en throne and na from der E dey rule evritin.


I know sey yu go ask sey, “Wetin make God dey find fault for pipol body, since na-im make us dey do as wi dey do?”


But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow. Yes! God dey laf dem well-well.


“So make una pray like dis: “ ‘Awa Papa wey dey for heaven, wi praiz yor name,


My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on.


Bikos God dey great and evribody must praiz and respet am pass oda gods.


So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!


E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do.


Dem go drive yu komot from where human being dey and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu kon sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka