Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 115:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 God go remember and bless us. E go bless Israel pipol and di priests wey bi Aaron shidren-shidren.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 115:12
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Di Pesin wey dey remember and fight for us wen wi dey trobol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,


I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.


God sey, “Israel pipol, make una remember sey una bi my savant and I nor go ever forget una.


And if e bi sey una bilong to Christ, den una bi Abraham shidren and pipol wey go inherit wetin God promise.


Make E bless us, den evritin for di eart go gi-am di honor wey bi en own.


so thru Christ, Abraham blessings go kom meet Gentile pipol and wi go receive di Spirit wey God promise us, thru faith.


Make Yu nor remember di sins wey I kommit wen I yong. Remember mi for di lite wey yor love wey nor dey fail dey bring, bikos Yu my God, dey sorry for pesin.


But God remember Noah and all di animals wey dey inside di boat. So E make one breeze blow for di eart, den di wota kon dey dry small-small.


So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”


Fear katch am as e dey look di angel, so e ansa, “Oga God, Wetin yu wont?” Di angel tell am, “God don hear yor prayer and si all di good tins wey yu dey do for poor pipol.


So my name go always dey Israel pipol mout and I go bless dem.”


So, Israel pipol, make una praiz God! Aaron shidren-shidren, make una praiz God!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka