Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 115:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God! Nor bi wi get di glory! Nor bi wi, but make all glory bi yor own, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 115:1
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na bikos of mi, I dey do am. Yes! I dey do all dis tins bikos of mi. I nor go fit let una spoil my name. I nor go let anybody share my glory with mi.


But I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt.


Make una give God di glory wey bi en own! Make una bring una ofrin as una dey enter en temple.


Israel pipol, I wont make una know sey I nor dey do all dis tins bikos of una. So make una shame and hide una face bikos of all di bad tins wey una don do. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


So, make all praiz and glory bi en own, bikos of en free grace wey E give us, thru en pikin wey E love well-well.


“Naw, make yu go tell Israel pipol dis message wey mi God wey get pawa get for dem: Wetin I won do nor bi bikos of una, but na bikos of my holy name; di name wey una don disgrace for evriwhere.


So make Yu forgive us! Make Yu kwik hear and ansa us. Nor bi just for yor town and en pipol, but na to make pipol honor and praiz yor holy name.”


Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.


Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”


Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.


Just as Yu promise awa grand-grand papa, Abraham and Jakob, na so too Yu go show us yor faithfulnes and love wey nor dey fail.


My God, make Yu raiz-up kon fight for mi. Make Yu remember as dis fools dey curse Yu evriday.


I bow kon woship Yu for yor holy temple. I dey praiz yor name, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail; bikos Yu don make yor promise and e high pass di sky.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka