Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 114:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Di mountins jump like goat and di hills run like lamb.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 114:4
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Smoke kover Mount Sinai, bikos God land on-top di mountin with fire. Di smoke dey go up like oven own and di mountin kon dey shake well-well.


Den di pipol si di tonda and di lite. Dem hear di horn sound kon si di mountin wey smoke kover and wen di pipol si all dis tins, fear katch dem, so dem kon waka far from di place.


Wen E stop, di eart go start to shake and wen E look, di nashons go bigin fear. All di mountins go skata; di hills wey dey since go sink and E go dey forever and ever.


Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.


My God, na di sea make Yu dey vex? Yu really dey vex for di river dem? No! Yu dey kom with yor shariot kon save us!


E make Mount Lebanon dey shake like small animal kon make Mount Hermon dey jump like small melu.


Fear kon make di pipol for di eart dey shake. Di mountins foundashon kon dey shake too; dem dey shake bikos God dey vex.


For God present, mountins dey shake and hills dey melt trowey. Wons God appear, di eart go shake and evribody for di world, go fear.


Yu mountin wey get many top, why yu dey jealous di mountin wey God won stay? True-true, God go stay der forever.


Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka