Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 110:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 But di king go drink from di wota wey dey flow pass for di road kon rule forever.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 110:7
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den I go win my enemies wey gada round mi! I go offa sakrifice for dis temple and shaut for joy! I go dey sing and praiz my Oga God.


Jesus kon go pray for di sekond time, “My Papa, if yu nor won take dis deat komot unless I die, den make wetin yu wont happen.”


Dem one know di time and di pesin wey God Spirit dey tok about. God don tok before about di sofa wey E sey Christ must sofa and di glory wey e go get.


Jesus kon tell Pita, “Make yu put yor swod back for where e dey before! Yu nor know sey I go drink from di sofa cup wey my Papa give mi?”


Dem nor tok sey di Mezaya go must sofa all dis tins and den e go enter en glory?”


Jesus ask dem again, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I won drink from?” Dem ansa, “Yes! Wi go fit.”


For di year wey dem make Evil-Merodak king for Babilon, e sorry for King Jehoiashin for Judah kon release am from prison. Dis tin happen for di twenty-five day for di twelft mont for di thirty-seven year afta dem take Jehoiashin go Babilon as prisona.


So, dis na wetin mi wey bi God dey tok about Jerusalem profets: ‘I go give dem bitter food chop kon give dem wota wey dem poizin, drink, bikos dem don spread sin for di whole land.’ ”


But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.


Make who sin karry di trobol by ensef; make dem feel God vexnashon.


Na ashes I dey chop as food and my tear dey rush enter my drink,


So God allow wota kom out from one place for di groun for Lehi, den Samson drink until e beleful. So e kon koll di place “En-Hakkore” and e still dey for Lehi till today.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka