Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 11:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 But God dey for en holy temple; E dey rule from heaven. E dey look as evribody dey live dia life for dis eart.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 11:4
28 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God don make heaven en throne and na from der E dey rule evritin.


But inside my trobol, I kry to God. Yes! I pray to my God make E kom help mi and E hear mi from en temple, bikos my kry rish en ear.


But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow. Yes! God dey laf dem well-well.


But Oga God dey en holy temple, so make evribody for di world, keep kwayet for en present.”


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


E nor get where pesin go hide put make I for nor si am. Yu nor know sey I dey evriwhere for di heavens and di eart?


God dey look from heaven. E dey from der look all di pipol wey E kreate.


So for di vishon, I si one throne for heaven wey pesin sidan put!


Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.


E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God.


And anybody wey take di temple swear, na both di temple and God wey dey stay inside, e take swear.


But I dey tell una naw sey, make una nor ever use heaven swear at-all, bikos na God throne e bi,


Na en great pawa E take dey rule forever. E dey si evritin wey di nashons dey do; so make wiked pipol nor dey karry body.


E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”


Bikos since di time wen I take Israel pipol komot from Egypt kon rish naw, I neva stay for any house. Na difren tent I dey stay for evriwhere.


“ ‘Heaven na my chair and na di eart I dey put my leg, so wish kind house una go fit build for mi or wish kind place I go stay?


God dey wosh evriwhere, E dey wosh both good and wiked pipol.


So, make evribody kwayet for God present, bikos E dey kom from en holy place.


Na mi wey bi God dey si and test human being heart. I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life and wetin e dey do.


E go know, bikos E know wetin dey evribody mind.


E good make wi sing praiz to God wey dey rule from Jerusalem. Make wi tell di world all di tins wey E do, wey dem nor fit forget.


Make pipol for evriwhere listin! Make evribody wey dey for dis world, listin to wetin I dey tok. God wey get pawa dey tok against una and E dey kom judge una from en holy temple.


God fit let dem stay for peace, but en eye nor go komot for dia body at-all.


God dey look evribody from heaven; E dey look to si if anybody really get sense and dey find am.


Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne?


Look mi well, den make Yu tell mi wetin I dey tink! Test mi and Yu go know wetin I wont!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka