Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 11:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 bikos wiked pipol dey wound innocent pipol anyhow. Dem hide for darkness dey shot good pipol with dia bow and arrow.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 11:2
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God sey, “Dis pipol bi like sojas wey don ready dia bows. Dem always dey ready to lie, bikos of dis, dem don get pawa for di land, but na wayo dem take get am. Dem don do many bad tins and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.


Wiked pipol dey use dia swod and bow take kill poor pipol, doz wey dem dey opress and doz wey dey raitious.


Dem go turn and run from Yu, bikos of yor arrow wey Yu shot.


Dem kon plan for sekret to arrest Jesus make dem for kill-am.


Wen I nor get pawa again, na-im dey protet mi as I dey waka. Bikos anywhere wey I dey go, my enemies don set trap dey wait for mi.


My God, make Yu do good to pipol wey dey good; doz wey dia heart and mind dey with Yu,


Pipol wey dey fear God, lite dey shine for dia body and doz wey get pure heart, dey always happy.


God good judgement go kom again and doz wey get betta and klean heart, go dey save.


Pipol wey dey fear God go happy, bikos of God and dem go dey save inside am. So make evribody wey dey do wetin dey rite, praiz God.


So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!


Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol. So make di evil trap wey dem set for oda pipol, katch dem.


If pesin nor gri turn from sin kom meet God, God go sharp en swod kon ready to shot en bow.


Na God bi my guide! E dey save doz wey get klean and true heart.


Wen David hear wetin Saul dey plan to do am, e kon tell Abiatar wey bi priest sey, “Make yu bring di efod kom.”


Saul kon sey, “I go give Mikal to David, so dat Mikal go bi trap for am and Filistia pipol go kill-am.” So Saul tell David, “Today, na di sekond time for yu to bi my in-law.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka