Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 11:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 I bilive and trust sey God go protet mi. So wetin make yu dey sey, “Fly like bird go hide for mountin, so dat yu go dey save,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 11:1
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I trust God well-well, so wetin go make mi dey fear? Wetin ordinary human being go fit do mi?


Na only Yu I trust, so make Yu nor let pipol disgrace mi or allow my enemies happy wen I fall.


David kon hide for di hill near Zif desert. Saul dey find David, but God nor let am katch am.


Dat time, some Farisee pipol kom meet Jesus tok sey, “Run komot for here, bikos Herod won kill yu.”


Just try komot yorsef from di trap like bird wey komot from trap or like deer wey eskape from hunta.


My God, make Yu protet mi, bikos I don run kom meet Yu for help.


Kush and Libya pipol nor get plenty sojas, shariot and many men wey dey ride horse for dem? But wen yu trust God, E kon give dem to yu.


But my Oga God, I trust Yu, bikos na Yu bi my God!


Doz wey dey loyal to Yu, dey trust Yu, bikos Yu nor dey leave doz wey wont make Yu help dem.


My Oga God, I don kom meet Yu make Yu protet mi. So make Yu save mi from doz wey won kill mi!


King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”


Jonatan koll di savant, “Make yu kwik! Run go kwik-kwik! Nor stop!” Jonatan savant take di arrow kon kom back kom meet en oga.


David kon tink am sey, “One day Saul go kill mi. So, di best tin wey I go do naw, na to run go stay Filistia pipol land. Den Saul go stop to look for mi for evriwhere wey bi Israel own and I go free from en wahala.”


Den, David from der go Mizpa for Moab, where e for tell Moab king sey, “I beg! Make yu allow my papa and mama stay with yu until I know wetin God won take mi do.”


Saul send pipol go guide David house and make dem kill-am wen day break. Den David wife, Mikal tell David, “If yu nor save yorsef dis nite, by dis time tumoro, yu go don bikom dead body!”


I ansa, “I nor bi di kind pesin wey dey run go hide. Yu tink sey I go won save my life kon go hide for di temple? I nor go do am.”


If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion and nobody go fit save mi.


Moab men, why una dey bihave like sey una get pawa or sey una strong well-well for war?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka