34 Make wetin I dey tink, make belle sweet am and I go rijoice bikos of my God.
Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!
Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
and my spirit dey happy bikos God, my Savior,
I go sing with joy bikos of Yu. Di Most High God, I go sing praiz yor name,
Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont
Dem always dey my mind and I nor fit stop to dey tink about di mighty tins wey Yu do.
So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!
I dey obey yor laws, bikos I love dem well-well.
na so wisdom dey good for di soul. Make yu get wisdom and yor future go dey sikure.
As evening dey rish, Isaak kon go di field go relax. Den e look kon si sey some kamel dey kom.
Den I go happy, bikos of my God. I go happy, bikos E save mi.
Make wi praiz en holy name and wi wey dey woship God, make wi happy.
So, I take di book from di angel hand kon chop am. True-true wen I dey chop am, e sweet like honey for my mout, but wen I swallow am, e kon bitter for my belle.