7 God show en good works to Moses and en faithfulnes to Israel pipol.
Naw, if really sey I dey good for yor eye, make Yu show mi yor way; so dat I go know Yu more-more kon kontinue to dey good for yor eye. Den I go si sey dis pipol, na yor pipol.”
E don show Jakob en word, kommands and rules for Israel pipol.
Dem forget wetin E don do, di great wonders wey E show dem,
Yu tish dem sey make dem keep di Sabat Day holy kon give dem yor laws thru yor savant, Moses.
Den Yu use Moses and Aaron take lead and guide yor pipol like many sheep.
E nor ever get any oda profet for Israel wey bi like Moses, wey si God face-to-face.
E tok to dem from di kloud wey kom as pila and dem obey en kommand and laws wey E give dem.
E give law to Jakob shidren kon tell en pipol Israel, wetin dem go do. E still kommand awa grand-grand papa sey make dem tish di laws to dia shidren,
Di pipol stay far from di place, but Moses waka near di tick kloud, where God dey.
God kom on-top di mountin kon sey make Moses kom meet am for der, so Moses kon go up.
All di pipol ansa, “Wi go do evritin wey di Oga awa God don kommand us.” So Moses go back go meet God kon tell am wetin di pipol tok.
and plenty wonderful tins for Ham and for di Red Sea.
My savant Moses nor bi like dat; e dey faithful for my house.
E don show en pipol en great pawa wen E give dem oda nashons land.