Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 103:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Na-im dey forgive pipol dia sins and dey heal difren-difren diziz.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 103:3
27 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.”


But dem wound am bikos of awa sin; dem beat am bikos of di bad tins wey wi do. Na di ponishment wey e sofa give us peace and en wounds don make us well.


My Oga God, I dey kry to Yu for help and Yu don make mi well.


My God, make Yu heal mi and I go strong again; save mi and I go dey save, bikos na Yu I dey praiz.


E heal pipol wey dia heart don break kon trit dia sore.


Di prayer wey dem take faith pray go save di pesin wey nor well and God go make am well. And if e kommit any sin, God go forgi-am.


But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.


Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey paralaiz, “My pikin, I forgive yu all yor sins.”


Den Moses kry to God kon sey, “My God, abeg make Yu listin to am.”


E go diliver Israel pipol from di wahala wey dem dey face, bikos of dia sins.


Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.


So David sey, “I don sin against God.” Natan ansa, “God don forgive yu, so yu nor go die.


Nobody for Zion go sey, “I know well or I dey sick”, di pipol wey dey der, God go forgive dem dia sins.


I dey keep my promise to tazon generashons. I dey forgive evil and sins. But I nor go fail to ponish wiked pipol with dia shidren-shidren. I go ponish di third and fourt generashon, bikos of wetin dia papa do naw.”


Dem sey, “E get some bad-bad diziz. E nor go ever get up from dat bed!”


Yu dey good and ready to forgive awa sins and pipol wey kom meet Yu for help, Yu dey show dem yor love wey nor dey fail.


But Yu always dey ready to forgive so dat dem go honor Yu.


Di pain wey I go thru na for my own good. Yu save my life from all di wahala kon forgive mi my sins.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka