1 Make evritin wey dey dis eart, shaut with joy to God!
So make all di eart shaut to God; make all of dem bigin praiz and sing for joy!
As e dey enter di road wey go Mount Olives, all di disciples kon dey happy, dey praiz God with loud vois for all di mirakles wey dem si.
Una wey dey Zion, make una shaut! Israel pipol, make una shaut too! Jerusalem pipol, make una dey happy and boast with all una heart!
So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!
God word still sey, “Gentile pipol! Make una happy with God pipol.”
Make di whole eart shaut with joy as dem dey praiz God!
My pipol, make una happy, bikos God go fight for en savant; E go pay en enemies back kon sorry for en pipol and dia land.
I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.
Evribody! Make una kom! Make una klap una hand! Make una shaut praiz God with klean mind!
Den God go bi king for all di eart; evribody go woship and know am as God.
Make strenjas happy well-well, bikos Yu dey judge pipol matter well and na Yu dey rule di world.
Evritin for eart go woship Yu; dem go sing yor praiz kon dey shaut for glory as dem dey koll yor name.”
God dey waka go en throne and pipol dey shaut and blow trumpet as E dey go.
So, make all di kingdom for di world sing praiz God! Make una sing praiz dis God,