Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 10:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Dem dey tell demsef sey, “No bad tin go ever happen to us! Wi go dey free from trobol forever!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 10:6
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But if na wiked savant, e go tell ensef, ‘My oga nor go kwik kom back’,


Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”


Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad.


As e karry ensef up, dey enjoy yeye life, na so di sofa and sadnes wey yu go gi-am, go plenty rish, bikos e tok for en mind sey, ‘I dey rule like kween, my husband neva die and I nor go ever si sadnes again!’


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


En enemies bi like dry shuku-shuku for bush. Yes! Dem bi like pesin wey don drink well-well. True-true, fire go burn dem like dry grass.


Dat time wen I don get evritin wey I nid, den I go kon sey, “Nor-tin go fit make mi poor again!”


Some pipol dey borrow money give odas without intrest and dem nor dey kollect bribe to lie for pesin head. Di pipol wey dey do dis kind tins, go stand gidigba forever.


Na only fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem nor good at-all and dia ways bad well-well. No one among dem dey do wetin good!


I bilive and trust sey God go protet mi. So wetin make yu dey sey, “Fly like bird go hide for mountin, so dat yu go dey save,


Yu sey, ‘I go bi kween forever.’ But yu nor tink about dis tins or tink about wetin go happen.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka