Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 10:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Dem dey prosper for evritin wey dem dey do. Dem nor dey si yor ponishment wey dey wait dem. Dem dey laf doz wey bi dia enemies.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 10:5
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.


So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”


Anywhere dem go, dem must fight skata di place


Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.


Just as dem sin for Gibeah, na so too dia sin and wikedness dey bad rish. God go remember dia sin kon ponish dem.”


So E make us si how E dey vex kon make us sofa di pains. En vexnashon dey burn like fire for evriwhere for Israel, but wi nor know wetin bin dey happen and wi nor still learn anytin from am.


Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.


Una own don finish! Una wey dey make wiked laws and dey opress my pipol.


Yes! Una dey play harp, tamborin, flute and dey drink wine for una party, but una nor undastand wetin God dey do,


Make yu nor jealous evil pipol or try to make friend with dem,


Wise pipol dey waka for di road wey dey lead to life and nor bi di one wey go take dem go grave.


E go still save yu from pipol wey dem nor fit trust;


From pipol wey live good life before dem bigin do bad-bad tins;


Dis na wetin dey happen to pipol wey play wayo take get propaty.


But one profet go meet Ahab kon tell am, “God sey, ‘Make yu nor fear doz many sojas! I go make yu win dem today and yu go know sey, na mi bi God.’ ”


Time kon rish for David and en men to attack Jerusalem. Jebus pipol wey dey der, tink sey David nor go fit win di town. So dem tell David, “Yu nor go fit enter here, even blind pipol and cripple, go fit win yu.”


Den Zebul tell am, “Nor bi yu sey, who bi Abimelek wey wi won serve? Dis nor bi di men wey yu curse? Go na! Make yu go fight dem!”


All of dem go dia vineyard go pick grape kon make wine take do party. Dem go dia god temple dey drink, chop and curse Abimelek.


God look di eart kon si sey e dey bad well-well, bikos all di pipol dey live wiked life.


God fit let dem stay for peace, but en eye nor go komot for dia body at-all.


bikos I dey jealous proud pipol wen I si dem dey prosper, even doh dem wiked.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka