Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 10:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol. So make di evil trap wey dem set for oda pipol, katch dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 10:2
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Bikos of di bad-bad tins wey dem dey tok, bikos of di evil wey dey dia lips, make dia own pride, bad mout and lie-lie, trap dem.


Nor let proud pipol opress mi or allow wiked pipol drive mi komot from my house.


and di trobol wey e plan for odas, dey fall for en own head. Na en own wahala dey kause trobol for am.


Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.


Abeg, make sure sey Yu bless mi and nor let sturbon pipol opress mi!


Make Yu klose dia lie-lie mout forever; doz pipol wey get bad mout and dey akuiz God pipol.


Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net and dia trap dey evriwhere for di road.


Doz wiked pipol wey hate yor laws don dig pit to katch mi.


Wiked pipol lie full my ear, but I dey obey yor kommands with all my heart.


Azaraya wey bi Hoshaaya pikin and Johanan wey Kareah born with di oda sturbon men for Jerusalem kon tell mi, “Na lie yu dey lie! Di Oga awa God nor sey make yu tell us make wi nor go Egypt.


Dead body dem go look yu kon ask demsef, “Nor bi dis man bin dey shake di eart kon make kingdoms dey fear?


Yu bin tell yorsef sey, “I go klimb go heaven go put my throne on-top di highest stars. I go sidan and rule like king for di highest mountin.


If to sey I fit live my life just as Yu tok


Naw, I know sey God big pass all di gods, bikos en pipol don dey save from Egypt pipol pawa; Egypt pipol wey wiked and like yanga well-well.”


Yu still dey karry body up and yu nor gri free my pipol.


Bikos e nor gri help oda pipol; e ponish poor pipol, doz wey nor get and e dey trobol doz wey nor get heart, till dem die.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka