Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Proverbs 7:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 and I si many men wey nor get sense, but I notis one among dem wey foolish well-well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Proverbs 7:7
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But man wey dey sleep with anoda pesin wife, nor get sense at-all and e just dey distroy ensef by ensef.


Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?


Jesus ansa, “Afta evritin wey I don tok so, una nor still undastand?


But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”


If pesin get sense, e dey show wen e dey tok, but if yu dey foolish, na stik dem go take beat yu.


“Pipol wey nor get sense, make una kom inside!” Den e go tell foolish pipol,


“Pipol wey nor know anytin, make una kom inside!” Den e tell doz wey foolish sey,


Una wey nor know anytin, make una get wisdom. Una wey nor wise at-all, make una try get sense.


Pipol wey nor know anytin, dey die bikos dem rijet wisdom and distroshon go follow doz wey bi fool, bikos dem feel sey wisdom nor koncern dem.


Dis words fit make pesin wey nor know anytin get sense and e go tish yong men how to work and get money.


Di tishing for yor word dey give lite, so even pipol wey nor go skool dey undastand am.


Wise pesin go si trobol dey kom kon run from am, but doz wey nor dey tink, go waka enter, den kon dey regret.


Wen I waka pass foolish and lazy pesin farm and vineyard,


Wise pipol dey si trobol dey run, but foolish pipol go run enter kon sofa pain.


E good make dem ponish who dey karry body up, so dat pipol wey nor know anytin, go get sense. As wise pesin, yu go get more wisdom wen yu take korreshon.


To wont betta life without wisdom nor good; bikos yu go enter trobol if yu nor dey patient.


Doz wey nor get sense dey wear foolishness as klot for body; but na wisdom bi wise pipol kap.


Doz wey nor get sense dey bilive evritin wey pipol tell dem! But wise man dey wosh en step.


Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.


God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


Di ones wey don marry wey dey sleep with oda pipol, go kover dia face make nobody si dem.


My pikin, make yu listin to my wisdom and put yor ear down for di words wey I dey tish yu.


My pikin, make yu do wetin yor papa tell yu and nor ever forget wetin yor mama tish yu.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka