2 Wetin I tish yu go make yu prosper and get long life.
So my pikin! Make yu listin to mi; make yu take evritin wey I dey tell yu sirious, den yu go get long life.
Wisdom go add more years to yor age.
I go bless dem with long life and give dem my salvashon.”
I pray make God wey dey give hope, bless una with joy and peace bikos of una faith. So make di Holy Spirit pawa full una body with faith.
Yu go live to enjoy yor shidren-shidren. Make peace always dey Israel land!
Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.
Obey God and yu go get long life; bikos wiked pipol dey die before dia time.
Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.
Since faith don make us dey good for God eye, wi don get peace thru awa Oga God Jesus Christ.
Wen e sey make Yu save en life, Yu do evritin wey e ask for and en family go rule forever.
Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol.
and bikos evribody dey do wetin dey rite, peace and sekurity go dey der forever.
Just as rice dey wait until den won harvest am, na so too yu go old before yu die.
so dat as long as di sky dey on-top di eart, una and una shidren go dey betta for di land wey God promise una grand-grand papa.
And if yu obey and keep my laws and kommand, just as David yor papa do, I go give yu long life.”
Na long life bi raitious pipol reward and to get white hair, na betta crown.
So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!
my papa go tell mi, “Make yu always remember wetin I tish yu. Do wetin I tok and yu go get long life.