Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Proverbs 26:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 E dey eazy to whip horse and kontrol donkey, but e nor eazy to kontrol foolish pesin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Proverbs 26:3
10 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

If pesin get sense, e dey show wen e dey tok, but if yu dey foolish, na stik dem go take beat yu.


Wish one una wont? Make I karry kane kom meet una, or make I kon show una di love wey di Spirit dey give pesin?


So, make yu nor bi like horse or animal wey nor get sense and wey nid kane to kontrol am.”


Wen I dey with una for my sekond visit, I tell una wey dey sin before about dis tins. Even doh I nor dey with una naw, I dey tok am again sey, if I kom again, I nor go sorry for anybody, but I go ponish am,


And wen una don show sey una dey fear God, wi go always dey ready to ponish doz wey dey disobey God.


Even if yu beat foolish pesin almost die, yu nor go fit beat en foolishness komot for en body.


Just as dem dey beat foolish pesin, na so too dem go ponish doz wey dey karry body up.


E good make dem ponish who dey karry body up, so dat pipol wey nor know anytin, go get sense. As wise pesin, yu go get more wisdom wen yu take korreshon.


Pesin wey get sense dey take korreshon if dem korrect am wons, but foolish pesin go only take korreshon afta dem don beat am well-well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka