Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Proverbs 26:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Just as bird dey fly pass, na so too, curse wey dem put for yor head and yu nor deserve am, nor go do yu anytin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Proverbs 26:2
10 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na how I wont take curse pipol wey God nor curse? Or how I go take distroy wen God nor send mi?


Make dem curse mi if dem like, bikos I know sey Yu go bless mi! Wen dem attack mi, na disgrace go follow dem! But mi, yor savant go always dey happy!


And dis na bikos Ammon and Moab pipol nor gri give Israel pipol food or wota drink wen dem dey komot from Egypt. Instead, dem give Balaam money make e curse Israel, but awa God turn di curse to blessing.


May bi God go si my sorrow and E go give mi some blessing wey go remove dis curse.”


Di Filistia man tell David, “I bi dog wey yu dey kom meet with stik?” Di Filistia man kon use en juju name take curse David.


Anybody wey dey waka up-and-down, bi like bird wey nor dey stay en house.


Moab wimen dey wait for Arnon River front; dem dey waka up-and-down like birds wey dem drive komot from en house.


Yu take Saul kingdom and naw, God dey ponish yu for all di pipol wey yu kill for Saul family. God don give di kingdom to Absalom yor pikin. Yu don fall; yu wey dey kill pipol anyhow!”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka