2 E good to dey honest, but na disgrace go follow proud pipol.
Pesin pride go distroy am, but if e dey honbol, pipol go respet am.
To fear God, dey bring wisdom and to honbol yorsef, dey bring honor.
“I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”
Respet dey kom before honor; but distroshon dey wait for proud pipol.
So, my king! Make yu follow my advise. Make yu turn from sin kom meet God; dey do good and sorry for poor pipol. Den yu go kontinue to prosper.”