Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Proverbs 1:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Proverbs 1:8
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My pikin, make yu do wetin yor papa tell yu and nor ever forget wetin yor mama tish yu.


“Di mout wey dey laf en papa and nor dey obey en mama kommand, bird from valley go plok am komot and vulture go chop am finish.


My pikin, make yu listin to wetin I dey tish yu and nor ever forget wetin I sey make yu do.


Na di words wey King Lemuel mama tish am, bi dis.


My pikin, wen sinnas tempt yu, make yu nor fall for dem.


Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.


I always dey remember di faith wey yu first get from yor grand-mama, Lois and from yor mama, Eunice. I dey sure sey e dey inside yu.


My pikin, make yu remember wetin I dey tok; nor forget wetin I sey make yu do.


My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do.


My pikin, make yu nor follow dat kind pipol or go near dem at-all.


If man sin against man, pesin fit beg God to forgi-am. But if man sin against God, na who go kon pray for am?” But di boys nor gri listin to dia papa, bikos God don sey E go kill dem.


Wen Jesus turn round si di woman, e kon tell am, “My pikin, make yu nor worry! Yor faith don make yu well.” From dat time, di woman kon well.


Some pipol kon bring one man wey nor fit waka kom meet am. Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey nor fit waka, “My pikin, make yu nor fear! God don forgive yu all yor sins.”


Why I nor obey my tishas! Why I nor do wetin dem tok?


Listin to yor papa; bikos without am, yu nor go dey dis world and wen yor mama don old, make yu still dey respet am.


“So wi, awa wifes, sons and dotas dey obey wetin awa grand-grand papa, Jehonadab kommand us and since den, wi neva drink wine;


So Rut go where Boaz dey kon do evritin wey en moda-in-law tell am make e do.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka