2 E rite dem so dat pipol go get wisdom, undastandin and good advise.
Trit wisdom like yor sista and undastandin like yor best friend.
Foolish pesin nor get time to spend en money to get wisdom, bikos e nor undastand wetin wisdom bi.
Una wey nor know anytin, make una get wisdom. Una wey nor wise at-all, make una try get sense.
E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
My pikin, make yu listin to wetin yor papa dey tish yu; put yor ear down and yu go undastand.
To fear God, dey bring wisdom and to honbol yorsef, dey bring honor.
So, if yu listin to wetin I dey tok; yu go know wetin dey rite, true and korrect, den kon know wetin yu suppose do.
Make una listin to wetin I dey tish una kon get sense. Make una nor rijet dem.
If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.