Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 8:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Levi pipol go klean and wosh dia klot, den Aaron give dem as special gift to God. E still do di sakrifice to make dem holy.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 8:21
10 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dis na how yu go take make dem holy: Sprinkol di holy wota for dia body, den tell dem sey make dem shave di hair for dia whole body kon wosh dia klot, so dat dem go dey holy.


For di third and sevent day, di pesin wey dey klean go sprinkol di wota for di unklean pesin body. For di sevent day, e go santify di man den di man go wosh en klot kon baf, den e go dey klean for evening.


“Afta dis, Levi pipol go-go do my work for di tent wey dem for dey do meetin. So yu must klean and give dem to God as special ofrin.


E must use klean wota take klean ensef for di third and sevent day, den e go dey holy. But if e nor klean ensef for di third and sevent day, e nor go dey holy.


“Si, I don use Levi pipol take replace all di first-born for Israel. So na mi get Levi pipol,


God tell Moses, “Make yu use today and tumoro take santify di pipol kon tell dem make dem wosh dia klot


So Moses, Aaron and Israel pipol kon offa Levi pipol, just as God kommand.


Di pipol do all di tins wey God kommand Moses about Levi pipol. So Levi pipol kon dey do di work for di tent where dem for dey do meetin and na Aaron and en sons, bi dia oga.


Di priest go take di pesin and di ofrin go di tent for God present.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka