Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 3:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

38 But di pipol wey go stay for di Tabanako front for east wey face di tent where dem for dey do meetin, na Moses, Aaron and en sons. Na dem go kare for di tins wey dem nid for di Holy Place and wetin Israel pipol wont. But if anybody wey nor suppose go der, go der, dem go kill-am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 3:38
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So yu go choose Aaron and en sons kon make dem do di work wey priests dey do; anybody wey try to do dia work for dem, make dem kill-am.”


But Levi pipol go kamp near di Tabanako to guide am, so dat nobody go-go near am kon make God strike Israel pipol.”


Naw, di pipol wey stay for east, where di sun for dey raiz, na Judah pipol, just as e suppose bi. Di pesin wey dey lead Judah pipol, na Nahshon, wey bi Amminadab pikin.


Di pesin wey dey lead dem na Zuriel wey Abihail born. Dis pipol go stay near di nort side for di Tabanako.


Na dem go kare for di Holy Place. Kohat family go stay near di sout-side for di Tabanako.


Gershon family go stay for di west side wey dey di Tabanako back yard.


Anytime wen dem won move di Tabanako, Levi pipol must take am go down and anytime wen dem won arrange di Tabanako again, na Levi pipol go karry am up. Anybody wey nor bi Levi wey go near am, dem must kill-am.


Di pilas for di kourt wey round am with dia socket, dia peg and dia ropes.


Na dem dey kare for di tent where dem for dey meet and di holy place. Dem still dey help dia brodas wey bi Aaron shidren-shidren, wey dey serve for God Temple.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka