59 Amram wife name na Jokebed, Levi dota wey dem born for Egypt. Di woman born Aaron, Moses and dia sista Miriam give Amram.
Amram marry en papa sista, Jokebed and e born Aaron and Moses. (Amram stay for one hundred and thirty-seven years, before e die).
Make una nor sleep with una papa sista; bikos na yor papa flesh, e bi.
Di boy sista stand for far dey look, so dat e go si wetin go happen to am.
Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.
Den Miriam and Aaron kon tok against Moses, bikos e go marry one woman from Ethiopia.
For di first mont, di whole kommunity for Israel go Zin Wildaness kon stay for Kadesh. For der, Miriam die and dem kon beri am.