Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 25:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Wen Israel pipol dey for Shittim, dem kon dey sleep with Moab wimen.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 25:1
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make wi nor follow ashawo life like some among dem, wey make 23,000 pipol die for one day.


Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.


Dem kon stay for Jordan River, from Bet-Jeshimot go rish Abel-Shittim for Moab.


But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.


My pipol, una nor remember how King Balak for Moab try to curse una, but instead na blessing Beor pikin Balaam, bless una? Make una remember as una travel from Shittim go Gilgal and mi, God do evritin wey I fit do to tish una sey I dey faithful.”


As sun dey shine di next morning, Joshua and Israel pipol komot from Shittim go Jordan River. Dem stay der before dem cross di river.


I still si sey, woman wey wont make man sleep with am, dey set trap for am and dis one dey wiked and bad pass deat. Pipol wey dey obey God, go fit eskape am, but doz wey dey sin, go enter di trap.


“Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol for di land, bikos wen dem bigin woship and sakrifice to dia juju, dem go koll una make una join dem, den una go chop from dia sakrifice;


“Make yu attack and distroy Midian pipol,


“Make yu ponish Midian pipol, bikos of wetin dem do Israel pipol. Afta yu don do am, yu go die.”


So wi stay for Bet-Peor Valley.


All of una si wetin God do for Baal-Peor. How E distroy di pipol wey serve juju for der.


wey dey chop di best for una sakrifice kon drink di wine for una drink ofrin? Make dem raiz naw kom help una; make dem kon save and guide una!”


Di sin wey wi sin for Peor nor bad rish? Till today wi neva fit klean awasef finish; e even bring wahala kom meet us wey bi God pipol.


By dat time, Israel pipol wey dey Moab, Ammon, Edom and oda kountry hear sey Babilon king allow some Israel pipol stay for Judah and e don make Gedalaya dia govnor.


“But dat generashon still rijet mi. Dem break my laws and dem nor gri keep my kommand wey dey give life to doz wey obey am. Dem distroy di Sabat finish. So, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish and I like to kill all of dem as dem dey di wildaness,


God sey, “Wen I first si Israel, e bi like wen yu si grape wey dey grow for desert. Wen I first si una grand-grand papa dem, e bi like wen yu first si ripe fig for en sizin. But dem go meet Baal for Peor kon dey woship am and dem kon bi like di juju wey dem love.


“Anybody wey follow animal sleep, dem must kill-am.


one small melu, one ram and one year man lamp for burnt ofrin;


Di men ashawo house wey dey di temple and di place where wimen for dey weave for Asherah juju, e distroy dem.


Den awa grand-grand papa join bigin woship Baal for Peor, dem even chop sakrifice wey dem offa give dead body!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka