Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 24:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 I dey go meet my pipol naw, but make I warn yu about wetin dis pipol go soon do yor pipol.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 24:14
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My pipol, una nor remember how King Balak for Moab try to curse una, but instead na blessing Beor pikin Balaam, bless una? Make una remember as una travel from Shittim go Gilgal and mi, God do evritin wey I fit do to tish una sey I dey faithful.”


Den Jakob koll all en sons kon sey, “Make all of una kom, so dat I go tell una wetin go happen for future.


But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.


Make yu undastand sey, for di last days before dis world go end, tins go hard well-well.


But, e get one God wey dey for heaven wey dey open sekret and tell dreams. E don tell King Nebukadnezzar wetin go happen for future. Dis na di dream and vishon wey yu si:


Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.


“ ‘Wen di last day don rish, God sey, “I go pour my Spirit inside evribody and all una shidren, both boys and girls go dey profesai, una yong men go dey si vishon and una old men go dey dream plenty dreams.


But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.


Naw, I don kom help yu undastand wetin go happen to yor pipol for di future, bikos dat na wetin di vishon dey tok-of.”


But afta, I go make Elam pipol prosper again. Mi, wey bi God, don tok.”


But di day dey kom wen God go make Moab prosper again. Dis na wetin God sey go happen to Moab land.”


God go gada dem put for pit, lock dem for prison and afta dem don stay der tey, E go kon ponish dem.


‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.


Den Balaam and Balak kon go dia house.


Israel pipol kill Balaam (wey bi profet) wey Beor born.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka