Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 24:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Wen Balaam si sey God wont make e bless Israel, e nor kon go meet God as before, but e turn waka go near di wildaness.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 24:1
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’


Balaam tell Balak, “Make yu stand for here near yor burnt ofrin and I go-go pray and anytin wey God show mi, I go tell yu.” So only Balaam kon go on-top di hill.


But dis na wetin I get against yu: yu get some pipol wey dey follow wetin Balaam dey tish and na Balaam tell Balak sey make e curse wahala for Israel pipol. Na-im make dem sin wen e sey make dem chop juju food kon sleep with who nor bi dia husband or wife.


Remember sey na dis wimen obey wetin Balaam tok for Peor kon make di pipol sin against God. Dat na wetin curse wahala for God pipol.


So Balak take Balaam go on-top Peor for di wildaness.


E don kommand mi make I bless dem and wen God bless pesin, I nor go fit shange am.


Balaam kon tell am, “Make yu stand near yor burnt ofrin and I go-go pray to God.”


So Balaam get up for morning and e tell di prince dem wey Balak send sey, “Make una go una land, bikos God sey make I nor follow una.”


So Saul ansa David, “My pikin! Make God bless yu. Yu go dey prosper for evritin wey yu do.” So David go en own way and Saul kon go back.


So Saul take 3,000 strong sojas wey e selet from Israel kon go find David for Zif desert.


Si naw, I don know sey na yu really go bi king and yu go build Israel kingdom with yor hand.


So di eldas for Moab and Midian kon karry di curse money go meet Balaam. Dem meet Balaam kon tell am wetin Balak tok.


So Balak do wetin Balaam tell am kon give one melu and one ram for each altar.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka