Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 23:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 E don kommand mi make I bless dem and wen God bless pesin, I nor go fit shange am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 23:20
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But God tell Balaam, “Make yu nor follow dem go and make yu nor curse di pipol, bikos I don bless dem.”


“Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.


I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.


Even before I kreate di day, I bi who I bi and nobody fit eskape from my pawa. Na who fit shange or skata wetin I don do?”


Balaam ansa, “Even if Balak give mi all di silva and gold wey dey en palis, I nor go fit disobey di Oga my God kommand, even if na for small matter.


and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.


Balaam ansa am, “Naw I don kom, but I nor get pawa to tok wetin I wont. Na only wetin God tell mi, I go tok.”


Isaak kon dey shake well-well, so e ask, “Den na who kon give mi bush meat chop? I chop evritin before yu kom and I bless di pesin. And blessing go really follow am!”


So my name go always dey Israel pipol mout and I go bless dem.”


And naw, Yu don choose to bless my family so dat wi go dey with Yu forever, bikos if Yu my God bless pesin, di blessing go dey forever.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka