Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 22:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 God kom meet and ask Balaam, “Dis men wey dey with yu, na who dem bi?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 22:9
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But for dat nite, God kon appear to Abimelek for dream sey, “Na die yu won die so, bikos di woman wey yu take so, na somebody wife.”


Dat nite God appear to Balaam kon tell am, “If dis men sey make yu follow dem, ready make yu follow dem, but na only wetin I tell yu, na-im yu go do.”


(Dis man tok like dis, bikos naim bi di High Priest dat year. E tok true sey, Jesus go die for di whole Jew pipol, but e nor know wetin e tok,


Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.


For dat day wey God go judge evribody, many pipol go sey, ‘Oga God, wi use yor name prish God message, drive many demon komot from pipol body and do many mirakle.’


My king, yu si sey di stone kut komot from mountin, but nor bi human being hand kut am. E skata di iron, bronze, silva, klay and gold to pieces. God Almighty don show di king wetin go happen for future. I don tell yu yor dream and wetin e mean.”


So God ask Moses, “Wetin dey yor hand?” E ansa, “Na stik.”


Den Josef tell Fero, “Di two dream wey Fero dream get di same meaning. God don show Fero wetin E wont do.


But God kom meet Laban for dream for nite kon tell am, “Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.”


Di angel tell am, “Hagar, Sarai savant, where yu from kom and where yu dey go?” Hagar ansa, “I dey run from my madam, Sarai.”


Den Oga God ask Kain, “Where yor broda dey?” Kain ansa, “I nor know! Na mi dey keep my broda?”


Balaam ansa dem, “Make una stay here dis nite and I go tell una anytin wey God tell mi.” So di eldas for Moab kon stay with Balaam.


Balaam ansa, “Balak wey Zippor born, wey bi di king for Moab, naim send dem kom meet mi sey,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka