Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 22:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 God angel kon tell am, “Wetin make yu beat dis donkey three times? Si, I kom here kon stop yu, bikos wetin yu dey do, I nor like am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 22:32
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

kon tell am, “Yu devil pikin wey nor like good tin, na so-so wayo and bad tins yu sabi do, yu nor go stop to dey oppoz God?


Dey always tok trut and e go save yu, but if yu dey play wayo, na wons yu go fall.


Den God vex sey Balaam follow dem, so God angel kon stand for road to stop am. Naw, Balaam dey drive di donkey and en two savants dey with am.


E betta to dey poor and honest, dan to dey rish and dey do wayo.


Doz wey dey do wetin dey good, dey fear God; but doz wey dey do wiked tins, nor dey fear am at-all.


My pipol, una nor remember how King Balak for Moab try to curse una, but instead na blessing Beor pikin Balaam, bless una? Make una remember as una travel from Shittim go Gilgal and mi, God do evritin wey I fit do to tish una sey I dey faithful.”


den why yu feel sey I know go sorry for Nineveh town wey dey for darkness? Place where en pipol many pass one hundred and 20,000 and wey get many animals.”


E dey give food to wild animals kon feed di yong birds wen dem dey kry.


God dey good to evribody. E dey sorry for evritin wey E kreate.


Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.


Make una nor stop una melu make e nor chop wen e dey harvest for una.


Dis pipol nor welkom una with food and wota wen una kom out from Egypt. Instead dem hire Balaam wey en papa bi Beor from Petor wey dey Aram Naharaim sey make e curse una.


But God angel ansa, “Make yu go with di men, but na only wetin I tell yu, na-im yu go tok.” So Balaam kon go with di prince dem wey kom from Balak.


So God open di donkey mout and di donkey tell Balaam, “Wetin I do yu wey make yu dey beat mi so? Yu don beat mi three times!”


Dat nite God appear to Balaam kon tell am, “If dis men sey make yu follow dem, ready make yu follow dem, but na only wetin I tell yu, na-im yu go do.”


Di donkey si mi kon turn from mi three times. If to sey e nor turn from mi, I for kill yu leave di donkey.”


Yu fit tink sey yu dey always do di rite tin, but na God know wetin dey rite to do.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka