Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 21:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Den di pipol go meet Moses kon sey, “Wi don sin, bikos wi don tok against God and yu. Make yu pray to God make E take di snake komot from where wi dey.” So Moses kon pray for di pipol.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 21:7
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Simon tell Pita, “Make yu pray to God for mi, so dat di tin wey yu tok so, nor go happen to mi.”


Wen God dey kill dem, dem kon dey beg make E sorry for dem. Dem turn to God kon take am sirious.


Di pipol kry go meet Moses make e help dem; so Moses pray to God and di fire kon stop.


Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”


King Jeroboam tell di profet, “Abeg! Make yu pray to di Oga yor God for mi sey, ‘Make E heal my hand!’ ” So di profet pray to God and di king hand kon strait again.


Fero kon sey, “I go let una go sakrifice give di Oga una God inside di wildaness, but una nor go-go too far. Make una pray for mi too.”


So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.


My brodas and sistas, I dey wish and pray to God from my heart evriday sey, make God save dem wey kom from Israel.


kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!” But dem sey, “How dat one take koncern us? Na yor business bi dat.”


I go leave my pipol until dem don sofa well-well for dia sin, den dem go dey look for mi. Yes! Dem go really look for mi bikos dem dey sofa.”


So King Zedekaya send Jehucal wey Shelemaya born and Priest Zefanaya wey bi Maaseaya pikin sey make dem kom tell mi make I pray make God kom help awa pipol.


Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!


So God kon sey E go distroy dem. But Moses, wey E choose kon stand between God and di pipol. E beg make God nor vex distroy dem.


Afta Job don pray for en friends, God kon make am rish for evry side again and E gi-am taims-tu of evritin wey e lost.


Naw, make una take seven ram and seven melu go give Job kon offa dem as sakrifice for unasef. Job go pray for una; den I go ansa una prayers and I nor go disgrace una again, bikos una nor tok di trut about mi just as Job tok.”


Saul ansa again, “I know sey I don sin, but make yu nor disgrace mi before all dis pipol. Abeg, follow mi make wi go woship di Oga wey bi yor God.”


Den Saul kon tell Samuel, “I don sin, bikos I nor obey God kommand and wetin yu tok. Bikos I dey fear di sojas, I kon follow wetin dem tok.


God vex well-well for Aaron and E won kon distroy am too. But I pray for Aaron and God kon sorry for am.


Di next day, Moses tell di pipol, “Una don kommit sirious sin; but naw, I go-go meet God, may bi E go fit forgive una.”


But Moses beg God kon sey, “My Oga! Why Yu dey vex with yor pipol wey Yu take komot from Egypt with great pawa and mighty hand?


Naw, make yu give di woman back to en husband, bikos true-true Abraham na profet and e go pray for yu and yu nor go die. But if yu nor gri give di woman back to en husband, make yu know sey yu must die with evritin wey yu get, even all yor pipol.”


Abraham pray to God and God kon heal King Abimelek, en wife and en wimen savants, so dat dem go fit get belle born shidren,


Jehoahaz kon tell God make E forgi-am and God ansa en prayer, bikos E si sey King Hazael really dey sofa Israel pipol.


God, wen wi dey pass thru pain, wi kry, pray and look for Yu, bikos of di way Yu dey ponish us.


Di frog go trobol yu, yor pipol and all yor savants for dis land.” ’ ”


Make una forgive mi for dis last time and pray to di Oga una God, so dat E go remove dis sofa from mi.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka