So I go use fire take distroy Moab town kon burn Keriot strong-strong buildings rish groun. Moab pipol go die for war and dia sojas go dey shaut and trumpet dey blow.
So, I go skata Rabbah town kon burn all dia strong-strong buildings rish groun. Wen di war start, pipol go dey shaut and e go bi like wen heavy breeze dey blow and strong rain dey fall.
But if e nor dey good for una eye, make Abimelek burn Shekem and Bet-Millo men with fire. Den fire go kom out from Shekem and Bet-Millo kon burn and kill Abimelek too.”
Den God tell mi, “Make una nor let Moab pipol wey bi Lot shidren-shidren vex. Make una nor kause wetin go make dem won fight una, bikos I nor go give una any of dia land, bikos I don give Ar to Lot shidren-shidren.
“Di shuku-shuku ansa, ‘If una really wont make I bi una king, den make una kom stay under mi. If not, fire go from my shuku-shuku branches burn Lebanon cedars.’ ”