Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 21:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 But Israel pipol kill dia enemy well-well kon take di land from Arnon River for nort go rish Jabbok and Ammon side, but Ammon sojas bin guide dia aria well-well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 21:24
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I distroy Amor pipol, bikos of my pipol; men wey tall like cedar tree and get pawa like strong tree. I distroy di fruit wey dey dia tree kon skata di rut for groun.


E kill King Sihon for Amor, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


Yu make dem win nashons, kingdoms and lands wey dey near dia own. Dem win Heshbon land, wey Sihon dey rule and Bashan land wey Og for bi king.


“ ‘Den I kon bring una kom Amor pipol land wey dey east for Jordan River. Dem fight with una, but I make una win dem; una kollect dia land and I distroy dem finish for una front.


For nite, Jakob kwik-kwik take en two wife, en two savant and en eleven shidren kon go Jabbok wotaside.


Na dis make us ask sey, ‘Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?’ ” Den dem kon notis sey, Jabesh nor follow dem gada for Mizpa.


and di ones wey E do to di two Amor pipol king for di oda side for Jordan River and dem bi King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan wey dey Ashtarot.


“Wen wi rish here, King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan kom fight us, but wi win dem.


Di aria from Gilead go rish River Arnon (Di main centre) go rish River Jabbok, wey dey Ammon pipol borda, I still give dem to Reuben and Gad tribe.


Den dem travel from der go di oda side for Amor for di wildaness wey wide from Amor, bikos Arnon na Moab borda wey dey between Moab and Amor.


And all King Og aria for Bashan, wey dey rule Ashtarot and Edrei (wey dey among di remainin pipol for Refah), go bi dia own too. Moses win dem kon take dia land.


Ammon king ansa, “Na bikos Israel pipol take my land, wen dem dey kom out from Egypt. Dem take my land wey start from Arnon River for sout go rish Jabbok River for nort and Jordan River for west. So make una give mi back, so dat peace go dey.”


Dis tin happen for Edrei, afta dem win King Sihon for Amor, wey en soja oga na Heshbon and King Og for Bashan wey en sojas oga na Ashtarot.


and as dem dey kamp for di valley near Bet-Peor wey dey east for Jordan River. (Amor pipol wey dia king bi Sihon wey bin rule form Heshbon, na dem get dis place before. But Moses and Israel pipol kom from Egypt kon distroy di king and en pipol.


God go ponish dis kountries just as E do to Amor pipol kings, Sihon and Og kon distroy dia land.


So God ansa dem, “Wen Egypt, Amor, Ammon, Filistia,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka