Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 20:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 “Make yu take di stik and yu and Aaron yor broda go gada di kommunity, den tok to di rock for dia front and wota go kom out. Like dis yu go bring wota out from rock for di pipol, both for dem and dia animals.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 20:8
31 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yu go still karry di stik follow body, bikos naim yu go take do many signs and wonders.”


Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.


Even bad animals go honor mi; jackals and ostrich go praiz mi wen I go make river flow for di desert, so dat di pipol wey I choose go get wota to drink.


Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne.


Dem kon dey pray togeda evriday with one mind, with all di wimen, plus Mary, Jesus Christ mama and en brodas.


Before naw, una neva take my name ask for anytin. Naw make una use my name ask for anytin wey una wont and una go get am, so dat una joy go full well-well.


Since una fit give una pikin good tins as una bad rish, wot of una Papa for Heaven wey go give di Holy Spirit to anybody wey ask am?”


Jesus ansa dem, “I tell una true word, if una get faith and una nor dey doubt, una nor go only do wetin happen to dis fig tree, but if una tell dis mountin, ‘Make yu move go inside di sea, e go-go.’


Wota nor hongry dem wen E take dem pass di desert; E tear rock open, Yes! E make wota flow kom out from di rock.


wey turn strong groun to where wota full kon bring wota kom out from strong rock.


E divide di rock and wota kom out kon form river for di dry land,


Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.


Wen dem dey hongry, Yu give dem bread from heaven and wen dem won drink wota, Yu give dem wota from rock. Yu tell dem sey make dem kontrol di land wey Yu promise to give dem.


Wen di sojas hear di ram horn sound, dem kon shaut well-well for war. Di town wall fall rish groun and di sojas run enter di town at wons kon win Jeriko pipol.


Wen una hear di trumpet sound, make di sojas shaut for war and di town wall go fall rish groun, den una go attack am.”


Di well wey di princess dig, wey di leaders open with dia septa and staff.” Dem travel from di wildaness go Mattanah;


di low valley wey rish Ar town klose to Moab boundary.”


Den Moses raiz en hand kon nak di rock two times with en stik. Plenty wota rush kom out, den evribody for Israel and dia animals kon drink beleful.


So Moses tell Joshua, “Make yu go choose some men for us, so dat una go-go fight Amalek pipol. Tumoro, I go stand on-top di hill with God stik for my hand.”


But make yu yorsef raiz yor stik kon take am divide di Red Sea, so dat Israel pipol go waka pass for dry groun.


Moses and Aaron do as Oga God kommand dem. Aaron use di rod wey dey en hand take nak River Nile for where Fero and en savants dey and di river turn to blood.


Den Moses take en wife and pikin, karry dem put on-top donkey kon go Egypt. Moses hold di stik wey God gi-am for en hand.


So God ask Moses, “Wetin dey yor hand?” E ansa, “Na stik.”


E get anytin wey too hard for God to do? As I tok before, nine monts from naw I go kom back and Sarah go born boy.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka