Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 20:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Why yu take us komot from Egypt kom dis evil place where nor-tin dey grow? No korn, fig, grape or pomegranate fruit for here. Wota to drink sef nor even dey!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 20:5
8 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yu neva take us go any land where milk and honey full or sey yu give us where get vineyard as awa propaty. Yu tink sey yu go fit deceive us? Wi nor go kom.”


As I take kondemn una grand-grand papa for Sinai wildaness, na so too, I go take kondemn una. Na God wey get pawa tok like dis.


Dem nor even ask sey, ‘Where God wey take us komot from Egypt? Di Pesin wey take us pass wildaness and desert, land wey nor good and dey dry, where pipol nor dey stay or travel pass.’


“Go tell evribody for Jerusalem sey: ‘God sey, “I remember as una dey faithful wen una dey yong. Una bin love mi well-well like woman wey just marry; una follow mi waka for wildaness and for dry land.


For forty years for desert, Yu give dem all wetin dem nid; dem nor wear tear-tear klot and dia leg nor swell-up bikos of pain.


Na dis God take una pass di wildaness wey get wiked snakes and skorpions; place where wota nor dey. But God make wota flow for una from rock kon


“Aaron nor go enter di land wey I promise to give Israel pipol; e go die, bikos una nor gri obey my kommand for Meribah.


Bikos for Zin Wildaness where di pipol for komplain against mi, yorsef komplain against my kommand wen yu suppose show how I dey holy, bikos of Meribah wota for Kadesh.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka