Yu go die for dat mountin wey yu go klimb kon go join yor grand-grand papa dem, just as Aaron yor broda die on-top Mount Hor kon join en grand-grand papa,
Why yu take us komot from Egypt kom dis evil place where nor-tin dey grow? No korn, fig, grape or pomegranate fruit for here. Wota to drink sef nor even dey!”
Moses pray for Levi tribe sey: “My God, Yu don give yor Tumin and Urim to doz wey dey fear and respet Yu. Doz wey Yu don test for Massah kon follow dem kworel for Meribah wotaside.