Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 20:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Den God tell Moses and Aaron, “Bikos una nor trust mi well-well to show di pipol how I dey holy rish, una nor go take dem enter di land wey I dey give una.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 20:12
26 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

And God sef still vex for mi, bikos of una. E tell mi sey, “Even yu, Moses nor go enter di land wey I promise una!


Wen I show di kountries how my name dey holy and great rish; di name wey una dey disgrace, dem go know sey na mi bi God. Mi, God wey get pawa, don tok.” “I go use una take show di kountries sey I dey holy.


Bikos for Zin Wildaness where di pipol for komplain against mi, yorsef komplain against my kommand wen yu suppose show how I dey holy, bikos of Meribah wota for Kadesh.”


“Aaron nor go enter di land wey I promise to give Israel pipol; e go die, bikos una nor gri obey my kommand for Meribah.


e nor doubt God promise. En faith make am strong and e tank God for evritin.


And God don bless yu, bikos yu bilive sey wetin E tok, go happen.”


But since yu nor bilive wetin I tok so, yu nor go fit tok again, until di day wen dis tins go happen.”


Jesus ansa dem, “Na bikos una faith too small and I tell una true word, ‘If una get faith wey small like mustard seed, una go tell dis mountin, “Make yu move from here go yonda” and e go move and nor-tin go hard una to do.’


Make yu remember sey, mi wey bi God wey get pawa, dey holy, so na mi yu must fear.


For una heart, make una make Christ una Oga God and make una ready to ansa anybody wey ask una about di hope wey una get.


Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.


Jesus kon ansa, “Una wey nor get faith and wey nor know wetin to do! How long I go dey with una? How long I go bear with una? Make una bring di boy kom here.”


Dis na wetin God wey get pawa dey tell Gog: “Wen dat time don rish, yu go start to tink of di wiked tins wey yu go do.


Afta I don bring una kom back from di kountries where I skata una go before, I go asept di sakrifice wey una go give and evribody go si sey I dey holy.


Na Samaria bi Israel main town and na King Pekah dey rule am. So if yu nor gri bilive or trust and put yor hope for God hand, den yu nor go fit stand and yu go really die.”


Di next day for early morning, dem mash go Tekoa Desert. Wen dem don ready to move, Jehoshafat kon stand sey: “Make una listin, una wey bi Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem! Make una trust di Oga una God and E go save una! Make una trust en profet words and una go win.”


“My savant Moses don die. So make yu get ready to cross Jordan River! Make yu take dis pipol enter di land wey I don promise to give dem.


Den God tell Moses, “Dis na di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob wen I sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ I don let yu si am, but yu nor go cross enter.”


Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.


E betta sey make Yu kill mi, dan sey make Yu dey trit mi like dis. If really sey Yu dey good to mi, den make Yu allow dis trobol pass mi.”


But God dey vex for mi, bikos of una and E swear sey I nor go ever cross Jordan River or enter di good land wey E go soon give us.


My Oga God! Yu really ansa dem. Even doh Yu bi God wey dey ponish pipol for di bad tins wey dem do, dem still si sey Yu bi God wey dey forgive.


For Meribah, di pipol make God vex kon put Moses for trobol,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka