Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 20:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 En and Aaron kon gada di whole kommunity for di rock front, den Moses sey, “Make una listin! Una wey sturbon well-well! Make wi bring wota out from rock for una?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 20:10
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body.


If una dey vex, make una nor sin and make day nor dark still meet una dey vex.


But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.


Una don dey sin against di Oga una God rite from di first day wey I know una!


Josef kon ansa Fero, “I nor get dat kind pawa, but God go tok thru mi, so dat yu awa king go dey okay.”


Dem ansa, “Wi dream one kind bad dream, but e nor get anybody wey fit tell us wetin di dreams mean.” Josef ansa, “Nor bi God dey tell pipol wetin dreams mean? Make una tell mi di dream.”


Pesin wey plant and di one wey wota, nor mean anytin, bikos na God dey make di seed grow.


I go stand wait yu on-top one rock for Horeb. Wen yu rish der, make yu nak di rock and wota go kom out for di pipol to drink.” Moses do as God kommand am and di eldas for Israel si evritin wey e do.


“Aaron nor go enter di land wey I promise to give Israel pipol; e go die, bikos una nor gri obey my kommand for Meribah.


E make wota kom out from di rock and e kon dey flow like river!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka