Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 20:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 For di first mont, di whole kommunity for Israel go Zin Wildaness kon stay for Kadesh. For der, Miriam die and dem kon beri am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 20:1
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So dem kon go shek di land from Zin and Rehob Wildaness, where dem dey pass enter Lebo-Hamat.


Dem travel from Ezion-Geber go Zin Wildaness, wey bi Kadesh.


Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.


Bikos for Zin Wildaness where di pipol for komplain against mi, yorsef komplain against my kommand wen yu suppose show how I dey holy, bikos of Meribah wota for Kadesh.”


Amram wife name na Jokebed, Levi dota wey dem born for Egypt. Di woman born Aaron, Moses and dia sista Miriam give Amram.


Den Miriam and Aaron kon tok against Moses, bikos e go marry one woman from Ethiopia.


Na mi bring and save una from Egypt where una for bi slave. I send Moses, Aaron and Miriam kom help una.


God vois dey make di wildaness shake. Yes! En vois dey shake Kadesh Valley.


bikos di two of una sin against mi for Israel pipol front for Meribah Kadesh wota for Zin wildaness, wen yu nor respet mi as yu suppose to.


Na thirty-eight years e take us to cross from Kadesh Barnea go River Zered and dat time, all di sojas for dat generashon die finish, just as God tell dem.


So wen wi kry to God, E hear awa vois kon send messenja, wey kom take us komot from Egypt. Naw, wi dey Kadesh, di town wey dey una kountry side.


So dem porshu Miriam komot di kamp for seven days and di pipol nor travel until dem bring am kom back.


Wen di kloud komot di tent, leprosy kon full Miriam body like snow. Den Aaron look Miriam, kon si sey leprosy full en body!


Den di pikin sista kon ask Fero dota, “Yu wont make I go find one woman among di Hibru wimen wey go fit kare for dis pikin for yu?”


Di boy sista stand for far dey look, so dat e go si wetin go happen to am.


Dem kom back kom meet Moses, Aaron and Israel pipol for Paran Wildaness wey dey Kadesh kon tell dem evritin wey dem si and show dem di fruit wey dem bring from di land.


So di whole kommunity for Israel komot from Kadesh go Mount Hor.


Bikos of dis, una kon stay for Kadesh tey well-well.


Wen dem komot from Egypt, dem travel pass di desert from di Red Sea till dem rish Kadesh.


Den dem go fight En-Mishpat (wey bi Kadesh) and dem win evry kountry wey dey for Amalek aria, even Amor pipol wey dey stay Hazazon Tamar.


Den Moses remove Aaron priest klot kon wear am for Eleazar. Aaron die on-top di mountin, den Moses and Eleazar kon kom back.


Di boundary for sout na from sout-west for Tamar go rish Kadesh Meribah; den go rish nort-west along Egypt boundary for Mediterranean Sea.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka