Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 2:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Naw, di pipol wey stay for east, where di sun for dey raiz, na Judah pipol, just as e suppose bi. Di pesin wey dey lead Judah pipol, na Nahshon, wey bi Amminadab pikin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 2:3
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na Ram bi Amminadab papa and Amminadab born Nahshon wey bi shief for Judah tribe.


and na Amminadab born Nahshon. Nahshon na Salmon papa


Ram na Amminadab papa, Amminadab born Nashon, Nashon kon born Salmon,


Bikos na Judah strong pass, dem kon make am leader among en brodas, but na Josef dem still take as first pikin.


and for di peace ofrin: e give two melu, five ram, five man goat and five man lamb wey bi one year. Dis na di ofrin wey Nahshon, wey Amminadab born, give.


Di one wey give en ofrin for di first day na Nahshon wey Amminadab born and na from Judah tribe e from kom.


Aaron marry Elisheba wey bi Amminadab dota and Nahshon sista. Di woman born Nadab, Abihu, Eleazar and Itama for Aaron.


Di pipol wey dem kount for dis group na 74,600.


But di pipol wey go stay for di Tabanako front for east wey face di tent where dem for dey do meetin, na Moses, Aaron and en sons. Na dem go kare for di tins wey dem nid for di Holy Place and wetin Israel pipol wont. But if anybody wey nor suppose go der, go der, dem go kill-am.


As Israel dey for di land, Reuben kon go sleep with Bilhah, en papa girl-friend and Israel kon hear wetin happen. Jakob get twelf sons:


Di sons wey Leah born na Reuben wey bi Jakob first pikin, Simeon, Levi, Judah, Issakar and Zebulun.


Naw, di men wey go help una, na dia names bi dis: from Reuben tribe, Elizur wey Shedeur born; from Simeon tribe, Shelumiel wey bi Zurishaddai pikin; from Judah tribe, Nahshon wey bi Amminadab pikin; from Issakar tribe, Netanel wey Zuar born; from Zebulun tribe, Eliab wey bi Helon pikin; from Josef sons: from Efraim tribe, Elishama wey bi Ammihud pikin and from Manasseh tribe, dem pick Gamaliel wey Pedahzur bi en papa; from Benjamin tribe, Abidan wey Gideoni born; from Dan tribe, Ahiezer wey Ammishaddai born; from Asher tribe, Pagiel wey Okran bi en papa; from Gad tribe, Eliasaf wey Deuel born and from Naftali tribe, dem pick Ahira wey bi Enan pikin.”


Wen yu blow alarm, di pipol wey dey di east side must start to travel.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka