Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 18:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Dem must kare for yu and di whole Tabanako. But dem must nor kom near di holy tins for di Holy Place and di altar or all of una go die.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 18:3
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen Aaron and en sons don kover di Holy Place and en tools finish; wen time don rish for di pipol to travel, Kohat pipol go karry doz tins; but dem nor go tosh anytin wey dey holy, bikos if dem tosh am, dem go die. Dis na Kohat pipol work for di tent.


Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.


Di work wey dem give Merari pipol join di frame for di Tabanako, na to kare for di cross bar, post, socket, tools and all di work wey dem dey do with dis tins.


Dia work na to kare for di box, tabol, lampstand, di altars and di tools wey di priest dey use for di Holy Place. Dia work na to kare for evritin wey dey dia list.


Di work wey Gershon pipol go do for di tent na to kare for di Tabanako, di tent kover; both for inside and outside, di curtain wey dey di tent gate where dem for dey do meetin,


But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”


Anytime wen dem won move di Tabanako, Levi pipol must take am go down and anytime wen dem won arrange di Tabanako again, na Levi pipol go karry am up. Anybody wey nor bi Levi wey go near am, dem must kill-am.


Dem must work with yu kon kare for di tent where dem for dey do meetin and for all di work wey dey di tent, but anybody wey nor kwalifai, make e nor work with yu.


From di ones wey dem give di oda pipol, make yu take one from evry fifty prisona and na di same tin for di animals. Yu go give all of dem to Levi pipol wey dey kare for Tabanako.”


Dem nor go serve as priest or go near anytin wey dey holy to mi or enter my Most holy place. Dis ponishment na for di yeye tins wey dem don do.


But Levi pipol go kamp near di Tabanako to guide am, so dat nobody go-go near am kon make God strike Israel pipol.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka