Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 18:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Di first-born wey dem give to God, weda na human being or animal, go bi yor own. But di first-born for pipol and di first-born from man animal wey nor dey klean, dem must replace am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 18:15
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Una fit use one lamb take buy donkey first pikin back, but if una nor go fit shange am, den make una break en neck. Una must buy all una first-born back. Nobody go kom meet mi with empty hand.


“Make yu dedikate all di first-born wey bi man for Israel give mi, weda na human being or animals.”


Israel pipol first sons use 273 take plenty pass Levi pipol own, so yu must buy di remainin shidren back.


bikos all di first-born na my own. Wen I kill all di first-born for Egypt, I keep all di first pikin for Israel for mysef, so both man and animal na my own. Na mi bi Oga God.”


“Make una give mi una plant and wine ofrin. “Una must give mi di first son wey una born.


Wen Fero nor gri free us, di Oga awa God kon kill all di first sons for Egypt, both human being and animal. Dis na di rizin why wi dey sakrifice all di first-born son give God, but wi dey buy dem back.’


Dem go take di shidren back wen dem don rish one mont kon pay five shekel for silva akordin to di sanctuary shekel.


All di first male wey una animal born, una go give dem to God. Make una nor use dem take go klear una field and make una nor shear dem at-all.


Make una kollect di money from doz wey dey keep am kon ripair anywhere wey spoil for di Temple.”


Di bread wey wi make from di first korn wey wi harvest for each year and oda ofrin like wine, olive oil and difren kind of fruits, wi go-go give dem to di priest for di temple. Wi go give Levi pipol one out of evry ten tins wey wi get from evritin wey wi plant for awa farm, bikos na dem dey kollect am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka