Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 18:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Yu must chop am for di Most Holy Place and evry boy pikin fit chop am, bikos e go dey holy to yu.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 18:10
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Anybody wey kom from di priest family fit chop am. Dem must chop am for di Holy Place, bikos e dey holy.


Di men among di priest family fit chop dis ofrin, bikos e dey holy.


Aaron and en sons go chop di remainin ones. Dem go take am make bread wey nor get yist kon chop am for di Holy Place where God Temple dey.


Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own,


Den e go kill di man lamb for di place where dem for dey kill lamb for sin and burnt ofrin. E must do dis tin, bikos na di priest get di sin and guilt ofrin and dem dey holy.


“Why una nor chop di sin ofrin for where dey holy? Na bikos e dey holy well-well naim make God give una make E for forgive di kommunity dia sins.


Make una chop am for di Holy Place, bikos dat na yu and yor sons own. Dis na wetin God kommand.


Di priest wey sakrifice di animal go chop am for di Holy Place inside God Temple where dem for dey meet.


Evry boy pikin wey Aaron born, must chop am. Na dis go always bi dia share wen ever dem offa ofrin to God. God go ponish anybody wey tosh di food ofrin, bikos e dey holy.’ ”


Out of all di ofrin wey holy well-well wey dem nor put for fire, dis go bi yor own: evry ofrin wey bi dia own, weda na from dia korn ofrin or from dia klean ofrin, or evry ofrin wey dem give mi, go dey holy well-well for yu and yor sons.


“And dis na yor own: special ofrin wey kom from dia gift, togeda with all di peace ofrin wey Israel pipol give. I don give dem to yu and yor shidren forever. Evribody wey dey klean for yor family, go fit chop am.


Di man kon tell mi, “Dis two buildings wey face di open space so, dey holy. Na for inside dem, di priest wey dey enter God present, for dey chop di ofrin wey holy pass. Bikos di rooms dey holy, di priests go put di ofrin wey holy pass for der: di korn wey dem sakrifice for sin or for ofrin.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka