Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 17:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Den God tell Moses, “Make yu bring Aaron stik kom back before di Testimony Box kon keep am as sign for sturbon pipol, so dat dia komplain go stop and dem nor go die.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 17:10
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box.


Make una nor let anybody deceive una with yeye word, na dis tins make God dey vex for doz wey nor dey obey am.


Heaven and eart, make una listin to wetin God tok: “Di shidren wey I train by mysef don turn against mi.


Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.


But all di wiked men among di ones wey follow David kon sey, “Since dem nor follow us go, wi nor go give dem anytin from di tins wey wi karry so. Make dem take only dia wifes and shidren dey go!”


Eli sons dey wiked and dem nor dey do wetin God kommand.


Una don dey sin against di Oga una God rite from di first day wey I know una!


Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.


Di pipol wey die bikos of dia sin, make una use dia kontaina take make wetin dem go take kover di altar, bikos dem offa am to God, so dem dey klean. Dem go bi sign for Israel pipol.”


Den Moses sey, “Dis na wetin God kommand: ‘Make una keep one full omer wey go dey from one generashon go rish anoda, so dat dem go si di food wey I dey give una for di wildaness, afta I take una komot from Egypt.’ ”


Oga God sey, “Israel pipol, na since una dey Gibeah una dey sin kom rish naw and una nor dey progress at-all. Una nor si as dem kill Gibeah wiked pipol for war?


Make una nor komplain like di way some for dem do before distroshon angel kon distroy dem.


Just as God kommand Moses, Aaron kon put am for di Kovenant Box front, so dat e go dey save.


Yu go put dem for di tent where dem for dey do meetin near di Kovenant Box where I for meet yu.


So Moses bring all di stik kom out from God present kon show Israel pipol and each pesin kon take en stik.


So Moses do wetin God kommand am.


So Moses take di stik from God present, just as God kommand am.


Make una remember and nor ever forget how una make di Oga una God vex for di wildaness. From di day wey una komot Egypt kon rish naw, una dey always sin against God.


“Make una nor allow God remove Kohat family from Levi tribe;


Den Moses and Aaron fall face groun for di pipol front.


“Make una komot from among dis kommunity, so dat I go distroy dem kwik-kwik.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka