Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 16:48 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

48 E stand between doz wey don die and doz wey dey alive kon stop di diziz.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 16:48
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den e build altar for der kon give God burnt and fellowship ofrin. So God ansa en prayer and di sickness for Israel kon stop.


So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.


And una dey wait en pikin wey dey kom from heaven. Dis na en pikin, Jesus wey E wake from deat and na-im go save us from God vexnashon wey dey kom.


Afta dis, Jesus kon si di man inside di temple. So e kon tell am, “Look, yu don well naw, make yu nor kommit sin again, oda-wise, di tin wey bad pass wetin do yu before, go happen to yu.”


But Finehas get strong mind kon stand for di pipol and di wahala and diziz kon stop.


Den God send fire kon distroy di two hundred and fifty men wey lite incense.


So all of dem take dia kontaina with incense kon lite fire put, den dem stand for di tent where dem for dey do meetin door-mot, with Moses and Aaron.


So Aaron do wetin Moses kommand and e run enter di pipol centre. Naw di diziz just dey start among di pipol. Aaron put di incense for der kon make dem holy.


Naw, di pipol wey die with di diziz na 14,700 plus di pipol wey die bikos of Korah matter.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka