Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 15:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 bikos e nor gri do wetin God tok or obey en kommand. Na en use en hand kill ensef.’ ”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 15:31
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol, but doz wey dey respet di law, go susid.


Wetin kon make yu disobey my kommand? Why yu do dis wiked tin? Yu kill Uriaya for war; yu allow Ammon sojas kill-am, den yu kon take en wife!


Na di pesin wey sin, go die. Pikin nor go sofa, bikos of en papa sin and papa nor go sofa, bikos of en pikin sin. Pesin wey good, God go pay am for en goodness, but wiked pesin go sofa di wikedness wey e do.


So, anybody wey rijet wetin wi tok; nor bi human being authority e rijet, but na God wey give una en Holy Spirit.


E don rish time wey God go take akshon, bikos dis wiked pipol dey break en laws.


“ ‘If dem koll yu make yu kon tok about sometin wey yu si or wey happen for yor present and yu nor gri, yu don sin bi dat and dem must ponish yu.


Bikos e for betta sey, dem nor know God at-all, dan sey afta dem don know am, dem kon turn back from di kommandment wey God give dem.


E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.”


All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own.


Bikos of dis, di Oga wey bi God for Israel sey, “Una don rijet dis message kon bilive una pawa wey bi to opress and deceive pipol. Yes! Una really love una bad karata.


I dey die inside my own sin and dis wahala too heavy for mi to karry.


All di pipol wey dey di land must komot first, make e for get komplete rest and dem must pay di prize, bikos dem rijet my law and kommand.


If una nor gri obey my law, kommand or keep di kovenant wey I make with una,


bikos dem go against God word, dem nor gri listin to wetin di Most High God tok


Anybody wey make perfume like am or take am rub strenja, dem go drive am komot from di kommunity.’ ”


If pesin dey klean and e nor travel, but e nor gri keep di Passova, make una remove am from among my pipol, bikos e nor give mi di ofrin for di rite time. E must sofa for di sin wey e kommit.


Anybody wey nor gri obey wetin di judge or di priest wey dey ripresent di Oga una God tok, una must kill dat pesin. Like dis, una go end bad and wiked tins for Israel.


So, I don swear for Eli house sey, ‘Dem nor go fit use sakrifice or korn ofrin take forgive di sin wey Eli family kommit.’ ”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka